BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
PDP national convention go hold despite all di kasala
As tins be, na caretaker committee of di group dey organise di PDP convention.
Yemen Houthis join di Iran war wit attacks on Israel, as US Marines land di region
Yemen internationally recognised goment don call out wetin dem say na Iran regular move to drag di kontri enta di kasala.
Tinubu address light matter, oda tins wey happun for APC convention
From 20 govnors afta 2023 elections, di APC now command 31 out of di 36 states for Nigeria going into di 2027 polls.
Why ICPC release Nasir El-Rufai
Former govnor Nasir El-Rufai don dey wit di anti-corruption body since 18 February wey later carry am go court.
Why UAE dey pay di highest price for US-Israel war wit Iran?
As di US-Israel war wit Iran enta di fourth week, di United Arab Emirates don become di obvious target for Tehran.
France uninvite South Africa from G7 summit sake of Trump? How Ramaphosa reply
One South African official bin tok on Thursday say, dem remove dem from di summit afta dem bin initially invite dem as e cite "sustained pressure from di US".
Trump don pause im plan to strike Iran energy plants by 10 days
President Trump post dis for Truth Social, as e announce di extension of di pause on striking Iranian energy plants on Monday.
Ginger Me
Special Tori
Wetin di 'No Kings' protest against Trump dey about?
Thousands on Saturday bin waka for street wit signs and plethora of high-profile Democrats wey go on stage for outside of di State Capitol building for St Paul.
Man die afta community flog am over alleged abuse of 10-year old girl
Tori be say di Ekowe community get tradition to flog pipo wey thief or rape pesin as a way to discourage odas.
Women wey dem secretly feem, den mock and abuse online
Women for Kenya and Ghana tell di BBC about di approach by one Russian man wey later posts dia videos without dia consent.
Oil and shipping: Africa get way out as crisis continue for Strait of Hormuz?
Iran war don reshape oil prices and shipping, squeezing Nigeria and Egypt but opening new routes through South Africa.
'Di gravest crime against humanity': Transatlantic slave trade kontris suppose pay compensation?
Di United Nations General Assembly don approve a resolution wey declare slavery "di gravest crime against humanity". Di resolution also dey urge "di prompt and unhindered restitution" of cultural items. Dis include artworks, monuments, museum pieces, documents and national archives - returning dem to dia kontries of origin without charge.
First female Archbishop of Canterbury don dey installed
Di Prince and Princess of Wales join di congregation for Canterbury Cathedral.
'If to say I listen to my mama dat day, I for no go jail' – Victim of EndSars protest regret afta six years in jail
Court declare Rasheed wey authorities arrest wen e be only 17 during di #Endsars protest, discharged and acquitted three weeks ago.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.












































