BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Nigeria to repatriate 'last set of' citizens from South Africa - wat next
Di Air Peace aircraft wey go fly 315 returnees dey expected to depart South Africa by 1:30am and land Murtala Mohammed International Airport, Lagos by 6:30am
Authorities arrest Adeniyi Adeyemi ontop fake agency PFIPC afta court arrest warrant
Abuja court don oder make dem arrest Adeniyi Adeyemi, wey present imsef as di Director-General of Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), e dey face criminal charges for di running di fake agency.
Appeal court put spanner for ADC congress, party counter Nafiu Bala list for 'Inec portal'
Tori dey fly upanday say one faction of ADC don upload details of dia candidates for Inec portal but ADC say na fake tori
Borno parents appeal for release of dia children wey gunmen kidnap same day wit Oyo schools abduction
One of di parents wey follow BBC News Pidgin tok Bukar Buba, say dem dey "furious" as dia own children wey dem kidnap di same day di Oyo incident happun still dey for captivity.
Why Ghana authorities arrest opposition NPP spokesperson Denis 'Miracles' Aboagye
Ghana authorities arrest opposition NPP spokesperson Denis Aboagye ova suspected offences wey include stealing, causing financial loss to di state, money laundering among odas.
Nigerian Army narrate how dem rescue Oyo kidnap victims, President Tinubu reveal dose behind di abduction
As army give details of how di rescue operation happun, president Tinubu also name dose wey dey behind di abduction.
Inec announce deadline extension for political parties to submit candidate lists for 2027 general elections
Wit dis deadline extension, di Nigerian political parties wey neva submit dia candidate lists go get more time to do dat.
'We go avenge di blood of our leader' - Iran supreme leader call for revenge ova father death
Mojtaba Khamenei say vengeance dey "inevitable" for di killing, wey happun on di first day of di US-Israeli war on Iran.
Pupils and teachers wey gunmen kidnap for Oyo State regain freedom, Tinubu assure dem of justice
Na President Bola Tinubu tok-tok pesin Bayo Onanuga make dis informate ontop im X page on Friday, 10 July.
Special Tori
'I no believe say dis go be im last operation' - Papa of soja wey die for Oyo kidnap rescue operation
According to di papa of di late soja, di Army no gree to dia request to release dia son deadi bodi.
Suspected herdsmen kill eight for gun attack during burial for Benue
Eight pipo don die afta gunmen attack Otukpo-Nobi for Benue State on Sunday night.
UK ban support for Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC)
UK Home Secretary, Shabana Mahmood announce say Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) go dey officially recognised as threat to national security.
Federal govment suspend Waec and Neco fees increment
Di Federal Ministry of Education make di informate for one statement wey dia Director of Press and Public Relations, Boriowo Folasade, issue on Monday, 13 July.
South Africa say dem deport ova 53,000 foreigners for di anti-migration campaign
South Africa say dem don send more dan 53,000 foreign nationals back either deported or repatriated since di campaign start five weeks ago.
'My mama deliberately make me sick for years until one doctor catch her'
Nina Blom spend years undergoing unnecessary tests and treatments afta her mama convince doctors say she dey seriously ill. She tell di shocking true story of how one doctor uncova di child abuse behind her supposed illness.
How man almost comot from plane through window of aircraft wey still dey fly
Ryanair confam say dem give one passenger medical treatment afta one incident ontop Malta Air flight, wey Ryanair dey operate.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































